Connect with us

America

Michael Jordan sneakers don sell for $2.2m

Published

on

Di signed sneakers wey Sotheby bin tok say go make from $2m to $4m na one of di most expensive Jordan tin wey don dey auctioned.

One jersey wey im bin wear for di 1998 NBA finals sell last year for $10.1m.

Di latest sale don mark Jordan as di most valuable athlete for auction of sports wear history.

Brahn Wachter wey be Sotheby oga of Streetwear and Modern Collectable.

Di last record for Jordan shoes happun for 2021, wen dem auction im Nike Air Ships for $1.47m.

Di Air Jordan XIIIs wey sell on Tuesday, na im Jordan wear for im last championship season wit di Chicago Bulls for 1997-98.

Jordan bin dey wear di size 13 shoes wen im score 37 points for Game 2 of di 1998 NBA Finals series, wey carry di Bulls to flog Utah Jazz, 93-88.

Afta dat di Bulls win di championship.

Na Jordan sixth NBA championship and di fifth time e gbab NBA Most Valuable Player.

Sotheby’s auction house say afta di Game 2 win, Jordan carry di shoe dash ball boy for dia locker room sake of say im help am find im jacket wey lost.

Di “Bred” (black and red) Air Jordans na di only complete sneakers wey Jordan wia for any NBA Finals wey go dey authenticated, according to Sotheby’s.

Jordan bin wear di first Air Jordan shoe for 1984 during im rookie season for di Chicago Bulls.

Di Air Jordan I come become available for sale di next year. So far, dem don drop like 30 different kain models of di Air Jordan.

Jordan win total of six NBA Finals championships, two Olympic Gold Medals and plenti oda accolaades dem.

Near and far, pipo don call am, di greatest athlete of all time.

 

Source: bbc.com

Advertisement
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Verified by MonsterInsights