ENTERTAINMENT NEWS
How BBC reported on Shatta Wale, Stonebwoy clash at VGMA19
Tension nearly spoil de 2019 Vodafone Ghana Music Awards after Dancehall artiste Stonebwoy pull gun for stage top.
Stonebwoy pull de video sake of Shatta Wale den en SM militants climb de stage at de time wey he Stonebwoy receive en award as Raggae/Dancehall Artiste of the Year Award.
For videos wey dey circulate for social media top, one dey see say the stage make butu-butu as menerz pull Stonebwoy go one side of de stage as he dey hold de gun which dey point downward.
Other videos show as Shatta Wale dey stand for one small platform top as de fight pae between dema supporters, wey he later komot from de stage.
Shatta Wale supporters say de SM Boss climb de stage sake of he wan congratulate Stonebwoy despite sey dem get beef.
Dem dey claim sey like dis be Shatta en move to bring peace between de Dancehall Artistes.
But Stonebwoy en supporters say e be justified sey he pull gun sake of dem no know what Shatta Wale en mind be as he climb de stage.
Dis be what Shatta Wale post for social media moments after de fight pae.
Police come de situation inside dem control de tensions.
Stonebwoy tweet sey Police give am protection until sey he catch house after de event.
Event organisers, Charter House withhold de announcement of two awards sake of de security challenge wey dem get.
Source: bbc.com
-
Lifestyle2 months ago
Road Safety Authority narrates how buttocks causes road accident
-
GENERAL NEWS2 months ago
Why 15 police officers stormed Owusu Bempah’s church – Kumchacha narrates
-
GENERAL NEWS2 months ago
Watch how Ibrahim Mahama rode Honda superbike to pay last respects to late friend
-
GENERAL NEWS2 months ago
How Offinso residents storm destooled queen mother’s house, demand for new chief
-
South Africa News2 months ago
Woman thrown out of a speeding taxi while on her way to work
-
GENERAL NEWS1 month ago
Deadly clash between youth and navy personnel results in two deaths at Tema Manhean
-
SHOWBIZ KONKONSAH1 month ago
Junior Pope’s Death: Video of John Dumelo refusing to join canoe for movie shoot over safety concerns resurfaces
-
News Africa2 months ago
‘Satanically dubious’ – SCOAN releases statement on BBC’s report about TB Joshua, church