Travel & Lifestyle

‘Every three to four months I dey grow tall’

Sulemana Abdul Samed

In 2015, Sulemana Abdul Samed wake up from bed only to realize en tongue suddenly make big inside en mouth he no dey fit breath well.

After getting some medication from de drug store wey reduce de tongue, de young Senior High School graduate no expect say that incident go change en life completely.

From that time till date, Sulemana popularly known as Awuche grow tall catch 9.6 feet and he still dey grow.

“Every three or four months I grow tall. If you no see me in three or four months wey you see me in another month, you go see say I increase,” Awuche talk BBC Pidgin Favour Nunoo.

Awuche en height turn am into celebrity for en hometown, Gambaga as de young, old, women, powerful den everyone wey encounter am dey look up in shock.

“One time, one policeman talk me say I break en record with my height, sake of that he go take picture with me” he recount.

Politicians, military personnel, police all dey excited when dem meet Awuche who apart from being de tallest man, be very warm, gentle and approachable to everyone.

“My height make me famous” he talk BBC Pidgin during visit to en home for Gambaga.

According to Awuche, whenever he show up for events people dey wan come close to am and he dey like that well-well.

De attention he dey get no dey worry am as he dey give people wey request to take picture with am de chance to do so.

‘Doctors say I dey suffer from gigantism’

Awuche en height no be normal, he get medical condition dem dey call ‘gigantism.’

Dis dey make he dey grow tall more than de average person.

“Last I go BMC, one of de whites see me wey he say dis guy get gigantism” he talk.

“That be de disease wey dey make your bone grow tall. De Doctor last write me letter say… de sickness inside me he for operate am for my head inside.”

He explain say sometin dey en head inside wey dem for remove so say de growth go stop.

Until dem remove dis, de growth go fit continue wey be dis dey affect en health and quality of life.

Despite all dis, Awuche say he get plans to marry, take wife and have kids den see how en kids go look like.

He no dey feel bad about de extreme height he get, be believe say that be how Allah choose am give am.

CLICK HERE TO DOWNLOAD PRESS RADIO MOBILE APP

“That be how Allah choose am give me, I be okay, I no get problem with de way God create me.”

Source: www.bbc.com

Ogyem Solomon

Solomon Ogyem – Media Entrepreneur | Journalist | Brand Ambassador Solomon Ogyem is a dynamic Ghanaian journalist and media entrepreneur currently based in South Africa. With a solid foundation in journalism, Solomon is a graduate of the OTEC School of Journalism and Communication Studies in Ghana and Oxbridge Academy in South Africa. He began his career as a reporter at OTEC 102.9 MHz in Kumasi, where he honed his skills in news reporting, community storytelling, and radio broadcasting. His passion for storytelling and dedication to the media industry led him to establish Press MltiMedia Company in South Africa—a growing platform committed to authentic African narratives and multimedia journalism. Solomon is the founder and owner of Thepressradio.com, a news portal focused on delivering credible, timely, and engaging stories across Ghana and Africa. He also owns Press Global Tickets, a service-driven venture in the travel and logistics space, providing reliable ticketing services. He previously owned two notable websites—Ghanaweb.mobi and ShowbizAfrica.net—both of which contributed to entertainment and socio-political discussions within Ghana’s digital space. With a diverse background in media, digital journalism, and business, Solomon Ogyem is dedicated to telling impactful African stories, empowering youth through media, and building cross-continental media partnerships.

Related Articles

Back to top button