Connect with us

News Africa

Nigerian Air Force helicopter crash for Port Harcourt

Published

on

Di helicopter bin take-off early Friday morning on 1 December heading to Rivers state wit plan for one operation against wetin di force describe as ‘economic saboteurs’.

According to di director of public relations and information for di Nigerian Air Force, Air Commodore Edward Gabkwet, di crash bin happun around 7:45am Friday morning.

“A Nigerian Air Force (NAF) MI-35P helicopter bin crash for Port Harcourt today, 1 December 2023. Di unfortunate incident bin occur around 7.45am wey no too long afta di aircraft bin take off for one operation against economic saboteurs for Rivers State.”

Na five crew members bin dey inside di helicopter as at wen e crash but di director confam say dem dey safe wit ‘minor injuries and dem dey receive treatment.

Air Commodore Gabkwet tok say di Chief of Air Staff don fly go Port Harcourt to go assess di situation

“Fortunately, di entire crew of five wey dey di aircraft bin survive di crash wit very minor injuries and dem currently dey receive attention at NAF Medical Centre Port Harcourt.”

“Di Chief of di Air Staff, Air Marshal Hasan Abubakar, currently dey road to Port Harcourt to check di situation for imself wia e go also see to di wellbeing of di crew and give further directives.”

Air Commodore Gabkwet add say dis kain incident na reminder of di different dangers wey di military dey go through as dem dey defend di nation.

Timeline of Airforce crash for 2023

For August 2023, one aircraft wey belong to di Nigerian Air force bin crash for Niger state.

Informate reveal say di aircraft bin take-off from Kaduna wia e dey go Minna before di crash happun for one village for Shiroro local goment Niger state.

According to Air Commodore Gabkwet, di aircraft bin dey go do evacuation mission wen e crash on 14 August.

“A Nigerian Air Force MI-171 Helicopter wey dey casualty evacuation mission bin crash, August 14, 2023, at about 1.1.00 pm chukuba Village for Niger State.

Dem try to rescue di pilot and oda passengers but dem no know di cause of di crash.

For July 2023, di news of anoda crash bin comot again as one aircraft wey dem dey use train for di Nigerian Air Force crash for Benue state.

Although NAF tok say nobody die for di crash, but two pilots wey dey onboard land hospital sake of di crash.

Dat time, dem setup panel to investigate di cause of di crash wey involve a fighter jet belonging to di NAF.

For February 6, 2023, a maritime patrol aircraft crash land for Lagos. Di aircraft bin dey routine flight before e lose tyres wey make am control di landing go Murtala Muhammed International Airport, Lagos.

 

Source: BBC

Advertisement
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Verified by MonsterInsights