Home / Uncategorized / Worker ask Elon Musk ontop Twitter: You don sack me?

Worker ask Elon Musk ontop Twitter: You don sack me?

One Twitter employee gat to enta social media to ask Elon Musk weda im still get work.

For tweet to di Twitter boss, Halli Thorleifsson say, “your head of HR no fit confam weda I get work or not”.

Oga Musk ansa am say, “Which kain work you bin dey do?”

Oga Thorleifsson tell di BBC say nine days afta dem freeze am from Twitter accounts, e no know weda dem sack am or not.

Afta plenti follow up questions and ansa with Elon Musk, wey be like interview for im job, oga Thorleifsson say e come get email wey confam say dem sack am.

Twitter no immediately ansa to di BBC request for comment.

Oga Thorleifsson, 45 bin dey work as senior director for product design. E tell BBC say di mata around im job bin dey “strange” and “extremely stressful” as tins be no clear.

E say “I open my computer on Sunday morning nine days ago and see say di screen bin dey grey and locked, wey mean say dem don lock me out of my Twitter accounts.

“Afta some days, I start to dey reach out to Elon and oga of HR to ask about my situation. HR email me two times but no fit ansa weda or not I still get work for Twitter”.

With frustration na im make am contact im oga at di top, Elon Musk.

 

Source: www.bbc.com

About admin

Check Also

Net 36 Vista Partners Lebanese Embassy …For Francophone’s Got Talent Show

    Renowned property  investment and management outfit Net 36 Vista has partnered the Lebanese …

UBA Marks Women’s Day with a Talk on Career Growth and personal branding

    UBA Ghana hosted a special International Women’s Day event to celebrate and empower …

Watch highlights of Partey’s goal-scoring performance against Bournemouth

Thomas Partey scored his third goal of the 2022/2023 Premier League season as Arsenal recorded …

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com