News Africa

TB Joshua Burial: Candlelight procession go kick-start burial of late Synagogue leader TB Joshua

Temitope Balogun Joshua.

Candle light procession for late Prophet TB Joshua go happun on Monday 5 July.

Dis na di event wey go kick-start di burial ceremony of di Nigerian preacher, televangelist, and founder of di Synagogue Church of All Nations (SCOAN) wey die last month.

Pastor TB Joshua die at di age of 57 on June 5, 2021 few days to im birthday.

Im death shock pipo and cause reactions from im congregation and leaders from around di world.

Although, di church no reveal di cause of im death.

For statement, di Synagogue Church of All Nations dem tok say: “God don take im servant Prophet TB Joshua home – as e should be by divine will. E spend e last moments on earth in di service of God. Dis na wetin dem born am for, e live for and died for.”

“As Prophet TB Joshua go always tok, “Di greatest way to use life na to spend am on something wey go outlive am”. Di church tok.

“Prophet TB Joshua leave legacy of service and sacrifice to God Kingdom wey go continue to live on for generations yet unborn.”

Di church add say Prophet TB Joshua last words na: “Watch and pray.”

‘TB Joshua candlelight procession na private ceremony’

Di candlelight procession na private ceremony, according to wetin di Synagogue Church of All Nations tok.

Di only details dem give na say, e go start by 6:30pm on Monday

Dem go also stream all ‘services’ live on dia TV channel.

For inside statement about di burial plans, Di church encourage pipo to get candle as a symbol and connect wit di programme for dia homes to “honour God’s servant – TB Joshua.”

TB Joshua Burial

WIA DIS FOTO COME FROM,LAGOS STATE GOVERNMENT

Over di weekend, Lagos State Goment go inspect facilities for di Synagogue Church of All Nations before di burial start.

Lagos State commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi, and Director-General of Lagos State Safety Commission, Lanre Mojola lead di delegation to visit di church during di weekend.

Dem tok say dis waka na to to inspect facilities inside di church to make sure say dem follow di Covid-19 safety and prevention protocols as dem dey prepare for di Pastor burial.

Di Health Commissioner say dem don tok with several stakeholders;

“We dey look at di airport, we dey look at di land borders, we dey look at event before di five or seven days of di funeral, we dey look at di funeral activities itsef, we don get detailed account of di programme, we dey put some guidelines in place.

“Any visitor wey dey come inside di kontri gatz to go through di mandatory seven days of isolation plus testing before dem fit participate for any of di activities.”

“We don inspect all di accommodation, we look di auditorium and we calculate how to completely remove di chance and di risk of infectious transmission”.

Pastor TB Joshua

WIA DIS FOTO COME FROM,SYNAGOGUE CHURCH

Details of other event for TB Joshua Burial

  • All-day tribute service go happun on Tuesday, 6th July from 10am (GMT+1) for di Synagogue, Church Of All Nations, Lagos, Nigeria.
  • All-night praise service go happun from midnight to 6 a.m. on Wednesday, 7th July for di Synagogue, Church Of All Nations.
  • On Thursday, July 8, lying-in-state service go happun for di Synagogue, Church Of All Nations from 11 a.m. to 5 p.m, di service dey open to di general public for pipo to pay dia last respects to di late man of God.
  • Laying to rest service and internment of di SCOAN leader go happun on Friday July 9.
  • Thanksgiving go follow on Saturday 11 July, 2021.

bbc.com

Ogyem Solomon

Solomon Ogyem – Media Entrepreneur | Journalist | Brand Ambassador Solomon Ogyem is a dynamic Ghanaian journalist and media entrepreneur currently based in South Africa. With a solid foundation in journalism, Solomon is a graduate of the OTEC School of Journalism and Communication Studies in Ghana and Oxbridge Academy in South Africa. He began his career as a reporter at OTEC 102.9 MHz in Kumasi, where he honed his skills in news reporting, community storytelling, and radio broadcasting. His passion for storytelling and dedication to the media industry led him to establish Press MltiMedia Company in South Africa—a growing platform committed to authentic African narratives and multimedia journalism. Solomon is the founder and owner of Thepressradio.com, a news portal focused on delivering credible, timely, and engaging stories across Ghana and Africa. He also owns Press Global Tickets, a service-driven venture in the travel and logistics space, providing reliable ticketing services. He previously owned two notable websites—Ghanaweb.mobi and ShowbizAfrica.net—both of which contributed to entertainment and socio-political discussions within Ghana’s digital space. With a diverse background in media, digital journalism, and business, Solomon Ogyem is dedicated to telling impactful African stories, empowering youth through media, and building cross-continental media partnerships.

Related Articles

Back to top button