News Africa

T.B. Joshua ‘explain’ why YouTube suspend Emmanuel TV channel from dia platform

 

Founder of di Synagogue Church of All Nations, Pastor T.B. Joshua

Founder of di Synagogue Church of All Nations, Pastor T.B. Joshua don explain why Youtube suspend di Emmanuel TV channel from dia platform.

Earlier, Prophet TB Joshua bin announce on di ministry social media platforms earlier say YouTube don suspend di Emmanuel TV You tube channel on top accuse of “Hate Speech” wey lead to plenty reactions from im members and pipo wey dey follow di ministry programmes for You tube and oda social media handles.

E post one video for im Twitter account wey e claim say na di reason Youtube suspend di Emmanuel TV channel from di platform.

For di video, di pastor bin tok say e get one man wey be gay, wey di spirit of man dey torment and no gree make e settle down wit woman.

Di pastor during prophesy time for service say “E get one gentleman for here, you get di spirit of man, you be man but you no how dis thing take happun. You wan settle down but you get heart for man.

“Di spirit of man dey torment you, you no fit help yourself. E get one time you get woman for your life but you no get time for her. Di spirit of man dey toment you, come out for deliverance.”

Di man come out and confirm say na true wetin di man of God tok.

E say im dey attracted to man, get relationship wit man. E say di sprit go dey tell am to mingle wit man and e don dey torment am for more dan 20 years. E add join say im go draw tatoo for hand to take attract men and get affair wit dem, even if dem no return im lust, e go dey do am to get sex wit animals.

For di announcement of di suspension for dia Twitter page, di ministry clear am say “Emmanuel TV mission na to share di love of God wit everyone – e no mata di race or religion – and dem strongly oppose all forms of hate speech! We don get long and fruitful relationship wit You Tube and believe say dem hurry make di decision.

Plenty pipo don react to di suspension of di channel.

According to reports, di channel get over 1,800,000 subscribers and 600,000,000 views before e chop suspension and e dey among di largest and most watched Christian ministry on top di video-sharing platform.

Source: bbc.com

Ogyem Solomon

Solomon Ogyem – Media Entrepreneur | Journalist | Brand Ambassador Solomon Ogyem is a dynamic Ghanaian journalist and media entrepreneur currently based in South Africa. With a solid foundation in journalism, Solomon is a graduate of the OTEC School of Journalism and Communication Studies in Ghana and Oxbridge Academy in South Africa. He began his career as a reporter at OTEC 102.9 MHz in Kumasi, where he honed his skills in news reporting, community storytelling, and radio broadcasting. His passion for storytelling and dedication to the media industry led him to establish Press MltiMedia Company in South Africa—a growing platform committed to authentic African narratives and multimedia journalism. Solomon is the founder and owner of Thepressradio.com, a news portal focused on delivering credible, timely, and engaging stories across Ghana and Africa. He also owns Press Global Tickets, a service-driven venture in the travel and logistics space, providing reliable ticketing services. He previously owned two notable websites—Ghanaweb.mobi and ShowbizAfrica.net—both of which contributed to entertainment and socio-political discussions within Ghana’s digital space. With a diverse background in media, digital journalism, and business, Solomon Ogyem is dedicated to telling impactful African stories, empowering youth through media, and building cross-continental media partnerships.

Related Articles

Back to top button