Connect with us

News Africa

How Nollywood mourn di death of Adejumoke Aderounmu wey die at di age of 40

Published

on

Popular Nollywood actress Funke Akindele don join oda Nigerian celebrities to mourn di death of dia colleague, Adejumoke Aderounmu.

Funke Akindele share di foto wey confam di death of di actress for her Instagram story.

Na one of her family member, Adeola Aderounmu confam her death on one post for im Instagram story.

E post say “You dey for beta place now my sister”.

Madam Aderounmu wey pipo sabi well-well as ‘Esther’ sake of her role for one popular television series, Jenifa’s diary die on 6 April at di age of 40.

Di cause of her death neva dey known. However, according to di family member post, dem don hold one funeral service for Aderounmu Adejumoke for Owu Baptist Church, Totoro area of Abeokuta for Ogun State.

 

Source: BBC

Trending

Verified by MonsterInsights