SHOWBIZ KONKONSAH

Gunman shoot TV journalist and one pikin dead for Florida

TV reporter Dylan Lyons, 24, and one nine-year-old girl have been fatally shot near Orlando, Florida, close to the scene of a murder that took place hours earlier.

Di same gunman, wey be suspect for di oda homicide also shoot and injure one second reporter, Jesse Walden, and di mama of di girl.

Di journalists bin dey cover di killing of one woman wen di teenage suspect return, police tok.

E no dey clear if dem be di target.

Di suspect bin dey armed wen dem arrest am and im bin no dey co-operate wit police, investigators tok.

Dem neva fit identify di oda two victims for di two attack wey happun on Wednesday for Pine Hills, one suburb west of Orlando.

For one news conference, Orange County Sheriff John Mina say di journalists bin dey “in or near dia motor”, wia im tok say no look like TV station official motor, wen dem attack dem at around 16:00 local time (22:00 GMT).

E tok say di Spectrum News 13 journalists bin dey report on a shooting wey happun earlier in di day at around 11:00 local time, wey see one woman for her 20s wey dem fatally shoot inside one car, wen di suspect return to di crime scene and open fire.

Afta e attack di journalists, di alleged gunman – Keith Moses, 19 – bin go into a nearby home and shoot di girl and her mama, di sheriff tok.

Di mama dey hospital for one critical condition, e add.

Oda journalists nearby help provide first aid to di victims, according to local reporters.

Spectrum 13 continue live coverage afta dem announce di death of dia reporter.

Greg Angel, one news presenter for di station, say di journalist wey injure “don fit speak wit investigators and colleagues”.

Oga Mina tok say di suspect,, “get one lengthy criminal history, to include gun charges, aggravated battery and assault wit one deadly weapon, burglary and grand theft charges”.

E describe him as “acquaintance” of di woman dem shoot in di morning, “but as far as we know, im no get any connection to di reporters and no connection to di mama and di nine-year-old”.

Wen dem ask about possibility say di gunman intentionally target di reporters, Oga Mina say “Na something wey we go take a look at”.

Im add say e also dey possible say di suspect mistake di journalists for police.

One reporter for Orlando TV station WESH 2 report say she and her camera operator bin don comot di crime scene only moments before di shooting.

“We get one gut feeling” and decide to leave for dia own safety, say Senait Gebregiorgis.

Charter Communications, di company wey own di TV station, releasd one statement dey call di attack “a terrible tragedy for di Orlando community”.

“We dey deeply saddened by di loss of our colleague and di oda lives dem senselessly take today,” di company tok.

White House Press Secretary Karine Jean-Pierre tweet condolences, say: “Our hearts go out to di family of di journalist dem kill today and di crew member wey injure for Orange County, Florida, as well as di whole Spectrum News team.”

Na 40 journalists dem kill for 2022, according to di Committee to Protect Journalists. Only one of di pipo dey di United States.

 

Source: www.bbc.com

Ogyem Solomon

Solomon Ogyem – Media Entrepreneur | Journalist | Brand Ambassador Solomon Ogyem is a dynamic Ghanaian journalist and media entrepreneur currently based in South Africa. With a solid foundation in journalism, Solomon is a graduate of the OTEC School of Journalism and Communication Studies in Ghana and Oxbridge Academy in South Africa. He began his career as a reporter at OTEC 102.9 MHz in Kumasi, where he honed his skills in news reporting, community storytelling, and radio broadcasting. His passion for storytelling and dedication to the media industry led him to establish Press MltiMedia Company in South Africa—a growing platform committed to authentic African narratives and multimedia journalism. Solomon is the founder and owner of Thepressradio.com, a news portal focused on delivering credible, timely, and engaging stories across Ghana and Africa. He also owns Press Global Tickets, a service-driven venture in the travel and logistics space, providing reliable ticketing services. He previously owned two notable websites—Ghanaweb.mobi and ShowbizAfrica.net—both of which contributed to entertainment and socio-political discussions within Ghana’s digital space. With a diverse background in media, digital journalism, and business, Solomon Ogyem is dedicated to telling impactful African stories, empowering youth through media, and building cross-continental media partnerships.

Related Articles

Back to top button