News Africa

‘I try to save am’- Fisherman narrate final moment wit di pilot of Tanzania plane wey crash kill pipo

Di plane crash site

One fisherman wey be one of di first responders for di site of Sunday plane crash, wey kill 19 pipo for Tanzania Lake Victoria, don describe how im try to save di pilots hook for di cockpit and how im nearly lose im life as im dey try to rescue dem.

Wen dem interview am from im hospital bed for di lakeside town of Bukoba, Majaliwa Jackson say im panick as im see di passenger plane approach from di wrong direction, before e dive into di lake.

Im rush to di scene wit three fellow fishermen and help to open di back door as im smash am wit one rowing oar wey help to rescue passengers wey bin dey siddon towards di back of di plane.

Oga Jackson say im later move to di front and dive enta di water.

Im and one of di pilots then communicate wit each oda as im make signs thru di cockpit window.

“E direct me to break di window screen. I come out from di water and ask airport security, wey don arrive, if dem get any tools wey dem fit use to break di screen.

“Dem give me one axe, but one man wey carry public announcement speaker stop me and break di screen. Im tok say dem don already dey in communication wit di pilots and e no get any leakage for di cockpit,” Oga Jackson tok.

Im add say afta dem stop am “im dive back and waved goodbye to di pilot”.

But di pilot show sign say im wan make dem rescue am.

“Im point out di cockpit emergency door to me. I swim go back up and carry one rope and tie am to di door and we try to pull am wit oda boats, but di rope break and hit me for face and knock me unconscious. Di next thing I know I don dey here for di hospital,” Oga Jackson tok.

Tanzania hold burial service for di victims

Tanzania Prime Minister Kassim Majaliwa dey lead mourners to pay dia respects for di funeral service for 19 pipo wey die afta one passenger plane crash enta Lake Victoria for Tanzania.

Di plane crash on Sunday morning near di shore for di end of di Bukoba airport runway.

Out of di 43 pipo wey dey on board, na only 24 pipo survive, according to wetin di operator Precision Air tok.

Di prayers dey hold for Bukoba football stadium,

Precision Air na Tanzania largest privately-owned passenger airline.Prime Minister Kassim Majaliwa  say dem go carry out extensive investigation to establish di cause of di crash.

Di plane comot from di commercial capital Dar es Salaam on Sunday and made a scheduled stop for Mwanza before e crash at around 08.50 local time (05:50 GMT) as e be dey near Bukoba airport.

Di airport don dey closed until further notice.

Fotos from di burial

CLICK HERE TO DOWNLOAD PRESS RADIO MOBILE APP

 

Source: bbc.com

Ogyem Solomon

Solomon Ogyem – Media Entrepreneur | Journalist | Brand Ambassador Solomon Ogyem is a dynamic Ghanaian journalist and media entrepreneur currently based in South Africa. With a solid foundation in journalism, Solomon is a graduate of the OTEC School of Journalism and Communication Studies in Ghana and Oxbridge Academy in South Africa. He began his career as a reporter at OTEC 102.9 MHz in Kumasi, where he honed his skills in news reporting, community storytelling, and radio broadcasting. His passion for storytelling and dedication to the media industry led him to establish Press MltiMedia Company in South Africa—a growing platform committed to authentic African narratives and multimedia journalism. Solomon is the founder and owner of Thepressradio.com, a news portal focused on delivering credible, timely, and engaging stories across Ghana and Africa. He also owns Press Global Tickets, a service-driven venture in the travel and logistics space, providing reliable ticketing services. In addition to his media ventures, Solomon serves as a Brand Ambassador for Alabuga, a prominent Russian industrial company, representing their interests and expansion across Africa. He previously owned two notable websites—Ghanaweb.mobi and ShowbizAfrica.net—both of which contributed to entertainment and socio-political discussions within Ghana’s digital space. With a diverse background in media, digital journalism, and business, Solomon Ogyem is dedicated to telling impactful African stories, empowering youth through media, and building cross-continental media partnerships.

Related Articles

Back to top button